+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

JAMB Nor Give 10,000 Direct-Entry Students Admission

E just clear say e pass 10,378 students wey wan use Direct Entry take enta university from 2023 academic year na JAMB nor gee give admission so.

JAMB  stop di candidate dem admission from different Polytechnics, College of Education, cus dem not gree send verification go give JAMB about di pipo dem results.

Last year February 2023, nai di bodi wey dey in charge of exam send message to Direct Entry pipo wey dey find admission to enta university for 2023/2024 academic year so that dem go use am take check weda dem make fake A-level results.

JAMB still tell di candidate for di message wey dem bring to to go meet their different skool to verify dem results first cus na only those wey dem skool verify their results nai JAMB go resin.

Di exam bodi write still tell different institutions to tell dem, some of dem don ansa with positive reply but over 240 still never bring anytin to JAMB.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM