+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Kidnapers For Imo Forest, Bring Out Deadi Bodi

Di Police Command Special Tactical Unit for Imo State on Monday don catch five tiff wey dey tiff human being as dem bust enta where dem dey hide for one forest wey dey between Avu and Ihiagwa.

Na di State Commissioner of Police, CP Aboki Danjuma join with local hunters go find di hidd out base on information wey dem get.

Di five gang all of dem come from Jau Local Govimet for Jigawa State. Dem name na Muazu Awuta wey be 30 yrs, Abdullahi Abubakar, 32 yrs, Ozeru Sabo, 25 yrs, Saddam Suleiman, 27 yrs, plus Bashir Yahaya 28 yrs.

Police say di five of dem dey tok and dem don dey on investigation to take catch di rest wey dey run.

Wey operatives dey check di forest dem see two deadi bodi wey don dey rotten and police say dem go do test to know who dem be, cus na pipo wey di gang tiff.

Other tins wey dem see for di forest na telephones, wristwatches, shoes, slippers, and five okada wey di Kidnapers dey use.

Security still dey luk di forest and some other places to make sure say dem clean di state.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM