+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Judgment Day: Supreme Court Stamp Govinor Sanwo-Olu As Lagos Govinor

Four govinors from opposition parties nai karey case go Supreme Court wey dem go hear how di jorjimet be today about di case of tins wey happen for 2023 election.

Na di case wey Gbadebo Rhodes-vivour di govinorship candidate for Lagos bring come Supreme Court against Govinor Babajide Sanwo-Olu  of Lagos state nai dem first jorje and wey Justice Garba Lawal don read di jorjimet finish nai he cancel wetin Rhodes-Vivour bring against Sanwo-Olu.

Di jorjimet now stamp Govinor Sanwo-Olu as di govinor for Lagos State.

Na seven govinor nai dem dey resin their case today, from Lagos, Kano, Zamfara, Plateau, Ebonyi, Bauchi, and Cross River.

Pipo dey dey di court na Govinor Abba Yusuf of Kano, diNew Nigerian Peoples Party (NNPP) candidate.

Join with others from Peoples Democratic Party’s (PDP) Bala Mohammed (Bauchi), Dauda Lawal (Zamfara) and Caleb Mutfwang (Plateau).

Even foma Govinor of Plateau State, Senator Simon Lalong still dey court.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM