+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Stop To Use ‘No Gree For Anybodi’ – Police

Police don dey warn pipo make dem nor dey use di slogan wey dey reign for everybodi mouth, ‘No gree for anybodi’ say di word nor good for security.

Na for inside one video wey Arise TV drop nai di Inspector General of Police, IGP Kayode Egbetokun take say di word wey full pipo mouth na wat to take do wahala.

Nai Egbetokun come dey say make pipo stop naw as dem dey warn cus police don do investigation to see say di slogan fit make serious gbege dey for di kontri.

‘No gree for anybodi’ just turn popular word for 2024 and naso pipo for social media dey use am take catch cruise.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM