+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Juguda Set Fire For Rivers State House of Assembly

On Sunday nite around 10’oclock  wey pipo dey sleep nai fire dey burn for Rivers State House of Assembly complex.

Di fire dey come just di time wey rumour dey fly about say some lawmakers for di state want make Govinor Siminalayi Fubara komot from seat.

Tori say na some jaguda boys nai troway one kind tin put inside di complex wey come start di fire.

But dem come quick off di fire with epp of firefighters and security agents wey still dey near di police command for di state.

One police man wey dey there but not gree call hin name say di burning of di complex na base on politics.

“Yes, na true. Di fire start around 9:30 or so for nite. But firefighters quick come to office am. I tik say na base on politics nai cus di fire.”

Other tori still tok say some of di lawmakers don already make arrangement how dem go take pursue di speaker of di house Eddison Ehie, so that dem fit impeach Fubara without stress.

[Punch/SA]

 

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM