+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kidnap Don Tiff JAMB Students For Benue

Students wey dey go write JAMB exam for Benue State nai bandits don tiff on Wednesday nite inside Benue link bus along Otukpo road.

Na 18 pipo nai dey inside di bus and dem dey go from Makurdi to Otukpo cus na there di center dey so dem fit meet up for Thursday. But around 8 nai di bandit waylay dem.

Dem say as di bandits jump out from bush dem karey all na only di driver and one pesin nai fit run di rest enta bush.

Police don start to dey find di jamb students but di Commissioner of Police for di state, Ifeanyi Emenari, say na14 passengers nai di bandits tif and na only one fit run.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM