+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Kitikata For Rivers Assembly As Gunshot Scatter For Air

No be small gun dey sound tartar for air inside Rivers State House of Assembly Complex for Port Harcourt come use teargas take top am down from security men.

Di rat race start on Monday wey some of di lawmakers sitdon start di process to take impeach Govinor Siminalayi Fubara for inside di assembly complex.

Na Speaker Martin Amaewhule nai sitdon as di head with some of di lawmakers as dem start di process to shift power komot from Fubara hand.

Dem come vote out leader of di House, Edison Ehie, and some other lawmakers wey dey loyal to di  govinor.

Know say na yesterday Sunday, around 10 for nite nai fire take burn one side of di assembly complex reach ground.

[The Cable/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM