+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

LGA Chairman Send Hire Killer To Kill Benue Speaker

Dem say na who stand for gate nai dey see different tin wey dey pass. Nai don be di case as one council chairman for Benue State colabo with anoda pesin make dem go delete the Speaker of Benue State House of Assembly, Aondona Hycenth Dajoh.

Police get to catch di chairman afta dem get info about di plan wey e don already map.

For di small investigation wey Police don do, ACP Olumuyiwa Adejobi wey be di Public Relations Officer for Abuja Command say di CP LGA  go karey hire killer make e go kputalize do House Speaker.

Di statement wey police bring say na di Force Intelligence Department – Intelligence Response Team, nai go arrest dem afta di infor wey dem get.

As e dey now, di two suspects deg with police and dey corporate dey give dem plenty ansa to wetin happen.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM