+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Lion Kill Nurse Wey Dey Take Care Of Am For OAU Zoo

Di skool of Obafemi Awolowo University wey get one  veterinary nurse that one mean pesin wey dey treat animal, lion wey dey for di zoological garden don kill di man.

Olabode Olawuyi, don bin dey take care of dis lion since di like na small baby before di animal dey kill am now so.

Wetin di University tokpesin, Abiodun Olarewaju tell di Cable news, say di 9yrs lion chop and kill Olawuyi on Monday afternoon.

He say na Olawuyi don bin dey in charge of di lion since dem born dem for 2014 inside di campus garden and na di nurse dey give dem food but dem nor know wetin make di man lion inside go kill Olawuyi yesterday.

Di tokpesin say pipo wey dey where di lion take dey bite Olawuyi try all dem best but to save dem Oga but di lion don already finish di man bodi.

Olarewaju say dem don use anger kill di yeye lion wey go chop e kipper.

Message sha don go reach Olawuyi family to tell dem sorry for wetin hapun to dem fada afta all di try wey di university do to save di man life.

Di VC of di skool Professor Adebayo Simeon BAMIRE, don say make dem investigate wetin really enta di lion to kill di man.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM