+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Dem Stop To Pay Govinors 13% Derivation Funds –Dr Mike Emu

Chairman for di host communities for Niger Delta Region, Dr Mike Emu say dem don dey tok to President Bola Ahmed Tinubu make e luk di 13℅ derivation funds wey Govimet dey pay to Govinor for oil producing states, to instead pay am direct to do host communities hand demsef.

Dr. Mike Emu give di charge for interview with our news pesin wey e dey tok about di mata wey dey di PANDEF chairman and elder stateman,  Chief Edwin Clark tok as he dey acuse Govinors for Oil Producing States say dem nor dey use di moni take dey develop di state. Say if dem pay di moni to di communitues direct dem know how to use am well for di region and complain nor go dey again.

Di chairman come still say na di elders and leaders in those days nai fight for dis 13% derivation for Niger Delta Region wey all dis govinors still dey for secondary skool and dem just come dey use di moni anyhow, he come dey blame foma President Olusegun Obasanjo as e go karey wetin di community suppose get go put for Govinors hand.

[FD]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM