+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Make Una Change Dat Early Mormor Exam, Kontri Pipo to JAMB

Joint Admission and Matriculation Exams, JAMB wey just start dem 2024 UTME on Friday 19 wey go dey till April 26, don get gbasgbos from Pipo mouth as dem complain why di board go put exam for 7 in di morning.

Pipo Wey Dey find admission to enta different university for Nigeria wey register JAMB pass 1.9 million and dem suppose reach dem exam CBT center by 7’0clock.

Di ones wey dem place far from their centers nai make pipo come start to complain say how dem wan take do am.

Na that one come make pipo enta social media dey bad mouth JAMB and know say di time wey dem put for di exam na 7, 10, and 12’0 clock. Naiem make pipo say make dem lok di time again sake of far distance problem.

But afta di first set write on Friday, wey di tokpesin of JAMB Fabian Benjamin dey tok on Sunday nai he say, he nor really mean say na dat 7 nai di exam go start.

But na for di student to quick reach there make dem relax and put tins in order bifor di exam go start fully.

Know say some pipo wey first write on Friday dey complain say dem get some problem for some centers, so di board say make dem relax, dem go give dek anoda date to write di exam.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM