If una wey be news pipo dey only tok about kidnap, bandits and bad tins wey dey hapun, e dey only give di krimina wetin dem want.
Na wetin Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris tok for di two days meeting wey news pipo do on Thursday for Abuja.
For di National Security Summit nai Idris say make news pipo too dey open eye see wetin President Bola Tinubu dey do and even security men and women press nor dey sing dem praise enough.
Nai he say di kind method wey presidency take dey fight insecurity media nor dey sing dos part and even 1.3 million student wey don benefit from di student loan scheme achievement, dey on a low key.
