+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nama Owner Kpai Husband and Wife For Ewu

Ewu Kingdom and di youths dey vex as dem dey call for justice unto wetin hapun to di husband and wife for dem kominiti wey Fulani cow owner go kpai.

Di husband and wife na from Gaberegolor village but evertin hapun wey dem get kwarel with di cow pipo cus dem use dem nama take match block wey di husband and wife just mould to build dem haux. Afta some days naso di husband and wife disappear.

Naso dem start to find di couple only to see dem deadi bodi with cutlass cut wey dey inside bush and near where water dey.

Kominiti president, Comrade Erhiegueke Emmanuel, and acting secretary, Engr. Obukadeta E. Joseph, say dis kind tin dem nor fit allow am slide like dat.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM