+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Don Save 15 Out of 26 Shidren Wey Bandits Tiff For Kogi

One skool wey dey for Zariagi along Kabba junction for Kogi nai bandits don go tiff 26 shidren and di owner of di skool wife on Sunday evening.

Di skool na Dahallukitab Group of skools and dey work as home to pipo wey nor get papa and mama hagain and na inside bush area dem gi build di skool puls say dem neva register with govimet.

But wetin di Kogi Govimet tok tru di komisiona for Information and Kominikation, Mr. Kingsley Fanwo on Monday for Lokoja, say police don try bring out 15 shidren out of di 26 and dem dey work to bring di rest and di owna of di skool wife out.

Di govimet nor hapi say di owna of di skool no regista and even karey am put for bush say dat way nor good.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM