Di mama wey use beating finish her 15 years dauta for Lagos come even karey knife wan take shuk her for Ipaja, Lagos State Domestic and Sexual Violence Agency, don charge am to court, and dump am for Kirikiri prison.
Di agency tok for X, say dem see di video and quickly put mouth inside as di Lagos Neighborhood Corps don fess hares di woman karey her go Ipaja station, then dem come karey di pikin go Child Protection Unit of di Ministry of Youth and Social Development make dem take care of di girl.
As pipo karey di mata for head di agency say dem like am and dey even dey tell dem say na dem go even make court quick judge di case with dem info.
