+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

My Mama Say Make I Nor Wear Short Dress Again – Ayra Starr

Nuba one Sabi girl Singer and Grammy award nominee, Oyinkansola Sarah Aderibigbe, wey we all dey call Ayra Starr, don show with anoda kind of dressing wey she say her mama want make she dey wear now.

Everybodi know say Ayra Starr na only short dress she dey lie wear but di singer say her mama don give her advise to stop all dis short skirt and start to wear long one.

Some pipo for X don dey happy say mama Sarah don tok to her pikin make she nor dey wear mini dress again.

Na for inside video wey she take dey dance for X nai she take tok so as she wear on long skirt with small top.

She write for di video, “My momi say make I dey wear long skirt now.”

Nai @ophicialrex reply her say: “Thank you mumi . Our girl don almost dey wear catapult.”

@Jbrandy_YBNL say: “Mama Celestina don las las tok to her dauta.”

But @phveektordrayne nor follow as e ask di singer: “You sef gree for her? Una don dey lose focus dis year o, wetin hapun to “no gree for anybody”?

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM