+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na 615k Nai Workers Wan Hear As Minimum Wage Bifor May End— NLC To FG

Everybodi for di works dey celebrate workers day and naso e be for Nigeria but as di celebration dey go on Nigerian Labour Congress and Trade Union Congress don say di only tin wey dem want na to hear di new minimum wage.

Yesterday wey be May 1, nai Federal Govimet bin say dem increase salary to 25% and 35% for six different govimet worker pipo.

But wey di organized Labour dey resin wetin Govimet tok, dem say salary increase nor be in dem wanr cus e nor go make any difference.

Di Union say make FG do wetin dem suppose do and and pay 615k as new minimum wage cus everytin dey on di high side for di kontri, from food, down to fuel and even light.

Nai di Leaders, Joe Ajearo and Festus Osifo for inside Eagles Square for Abuja take say make Govimet nor allow May end and dem nor hear anytin about di minimum wage, nai he say dem go close everywhere for di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM