+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Na Gov Ododo Epp Yahaya Bello Run, EFCC

No be small drama nai play for di Abuja hass of di foma govinor of Kogi State, Yahaya Bello on Wednesday afta EFCC say dem go arrest am come hide dey wait for kona.

On EFCC source wey yarn with tori pipo say dem go Bello hass for Wuse 4 dey wait make him come out so that dem go arrest am, chrage am to court on Thursday base on mata wey concern corruption.

Dem don dey there tanda dey wait, naso Govinor Usman Ododo wey be di Govinor of di state come enta di hass stay for some time bifor he komot but bifor EFCC go say jack robison, Ododo don use Bello run komot.

Even bifor di arrest wey EFCC go, di tin don dey be as e get cus as court tok on Wednesday say make ddm nor arrest di foma govinor.

Justice I.A Jamil for di State High Court for Kogi nai tell EFCC say make dem nor arrest or detain Yahaya Bello cus that one go be against he right, unless say dem get anoda kind order from di court.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM