+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija Army blast UN for the report dem drop on top Borno Killing

The Defence Headquarters don blast d report wen the United Nations drop say na 110 civilians nia Boko Haram badoo dem kpuff on Saturday wen dem attack farmers for the Jere Local Government Area of Borno State.

Wen the Coordinator, Defence Media Operations, Maj. Gen. John Enenche dey yarn dis one dis morning, he come talk say na 43 dead body nia dem recovered from the matter for take play for the Zabarmari area of the northeast state.

According to reports, the bad guys dem tie the farmers wen been dey work for their rice fields, before dem come cut their throats.

But wen Enenche come dey react to d matter on Monday, he come talk say d military count the dead body dem together with the locals and say na 43 deaths nia dem record.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM