+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija police dey find way to reach high standard

The Police Service Commission don launch one four-year strategic plan to reposition the Nigeria Police Force and dis one so go make the organization dey more accountable in line with international standards.

Wen the PSC Chairmo Alhaji Musiliu Smith dey open the 2019-2023 Strategic Plan for Abuja, he come talk say the vision of the agency na to give Nigerians better police force wen no go only dey accountable, but still dey respect human rights, he come talk say dis one so go dey possible through plans wen dem think well.

The commission come still say dem dey plan to arrange one electronic database of police personnel including the population of the force, their bio-data, years of enlistment, rank plus including others.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM