+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naija students protest for London

Nigerian students wen d Niger Delta Development Commission (NDDC) dey sponsor for abroad unto book matters dey hold protest in front of the Nigerian High Commission for London becos d commission neva gree release pepper for their scholarship.

The students wen dey protest represent many students wen dey for Batch 2018 of the NDDC foreign scholarship programme wen neva receive money yet for their school fees undermining say the NDDC say dem recently release more than $5.9 million for the programme.

Wen the students come dey voice for one statement, dem come talk say the NDDC management deliberately remove them from the latest payment for the scholarship programme.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM