+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naira Abuse: Cubana Chief Get N10m Bail From Court

Pascal Okechukwu court don bail am N10 million afta hin say he nor dey guilty di charges wey EFCC put for him head.

Di court say make Cubana chief priest pay N10m and still bring two surety wey go get that kind moni to stand for am.

Know say Cubana Chief Priest don bin tell Justice Kehinde Ogundare  say he nor do any bad tin against Nigeria moni.

Na EFCC na karey Cubana Chief Priest go court say hin dey spray and match moni for different party wey he enta.

Dem say for one particular one in di 13 of February 2024, naso Cubana spray N500 notes for a whipe two hours and that na against kontri law.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM