+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naira Marley And Sam Larry Want Police To Pay Dem N40m

Abdulazeez Fashola, wey dem dey call Naira Marley and Samson Eletu, aka Sam Larry, don karey magistrate and police go court say make dem free dem from police hand afta police arrest dem cus of Ilerioluwa Aloba, aka Mohbad wey die all of a sudden.

Na N20 million each nai di two of dem dey tell police and di Lagos magistrate court to pay dem afta Adeola Olatunbosun, tell police to keep Naira Marley and Sam Larry for station for 21 days.

Dem lawyer, Olalekan Ojo, SAN, say make di court free dem as di 21 days wey magistrate give don already pass.

Di suit wey dem write say, dem problem start since October 3 and 4, 2023 wey police take arrest dem say dem hand dey for werin kill Mohbad.

“On di 4th of October 2023,  di Commissioner of Police go meet Magistrates Court for Yaba to hold dem for 30 days.

“But na 21 days nai di Chief Magistrate Adeola Olatunbosun give police instead.

“Di 21-day wey Chief Magistrate Olatunbosun give don expire on October 26, 2023, and dem nor say dem add anoda days to am,” na wetin dey for di two suit.

[Punch/SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM