+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Naira Marley, Sam Larry For Stay For Custody For 21 Days

Magistrate court for Yaba side of Lagos state don put say make police still hold Abdulazeez Fashola (Naira Marley), Samson Eletuon  (Sam Larry) for dem hand as di investigation about Oladimeji Aloba, aka Mohbad death still dey on for police hand for 21 days.

Na 30 days nai police bin say make di court allow dem stay till dem go finish their investigation but Justice Adeola Olatunbosun come give di suspect only 21 days to stay.

Di case wey dey dem Naira Marley head na say dem hand dey for wetin kill Mohbad.

Di judge come add for di judgment day make police allow dem to see dem lawyer and see doctor if dem nor well for that 21 days wey dem go dey go custody.

 

[SA]

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM