+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police For Delta Catch Man With Codeine, Tramadol

 

To make sure say all di drug abuse case wey dey hapun go don kpatapkata for di state, police for Delta don arrest one man wey get plenty codeine join with other hard drugs wey hin wan sell.

Na on Sunday for X nai DSP Bright Edafe di public relations officer say na 572 units of codeine and tramadol nai dem see for di man hand.

As di police officer dey cry on di bad tin wey drugs dey do pipo wey dey inside, hin say na 375 bottles of CSP codeine, 44 bottles of CSC codeine, 120 sachets of tramadol 200mg, and 33 sachets of swinol capsules nai everytin be.

According to am, he say di work nor be here but dem nor go tire to dey fish out all those pipo wey dey sell hard drugs to young pipo for di state only to damage dem future.

Na last year Dec 2023, nai di National Drug Law Enforcement Agency, NDLEA, catch some pipo wey go buy millions of tramadol, codeine and bags of Canadian loud wey dem wan sell give pipo for di kontri.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM