+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

New Plan To Reintergrate Repentant Terrorists Don Start -FG

E never reach one week wey some Senators dey tok for di red chamber say dem want strong law to punish any terrorist but FG govimet don come with new way put terrorists wey repent back to society.

Na on Monday for Abuja nai wey dem dey do National Validation Workshop on di Standard Operating Procedures (SOPs) for Disarmament, Demobilisation and Reintegration (DDR) for states like Kaduna, Katsina and Zamfara nai di National Coordinator of Counter Terrorism Centre, office of di National Security Adviser, Maj Gen. Adamu Laka take open up about di new framework.

Laka say dem do am cus di kontri wan really fight insecurity without military way but dem go provide practical guidelines for di institutions wey go.handle di program so dat opennes go dey hakantable and strength go follow. And dem nor just come up with dis kind plan, na afta dem don collabo and tok with stakeholders finish.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM