+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NLC Don Enta Strike, ASUU Join

Nigeria Labour Congress, NLC, and Trade Union Congress, TUC, don gree say all dem members go start di strike wey dem decalre for midnite yesterday, 13th of November 2023.

Even sef Academic Staff Union of University, ASUU just send letter go give all dem pipo say make dem gum folow di strike.

Wetin cus di strike dey close to di tin wey happen to NLC president Joe Ajaero wey police and jaguda boys beat am use he eye take see oba for Imo State.

Dem come still say part from say na Govinor Hope Uzodimma nai send di jaguda boys, to go beat Ajaero, di govinor still dey own over 40 months salary.

For statement wey di general seketary of NLC Comrade Emmanuel Ugboaja and Comrade Nuhu Toro, seketary general of TUC sign, dem say  make all state councils make sure say dem tell all workers to follow di order today.

Know say on Friday last week nai court give order to NLC and TUC make dem nor do any nationwide strike.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM