+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

We Nor Join Di Strike — CONUA

Congress of Nigerian University Academics and dem members say dem nor join di strike wey Nigeria Labour Congress and Trade Union Congress declare.

Na inside statement wey di National President of CONUA, Niyi Sunmonuem, write and sign give tori men nai dem take tok am.

Dem say na cus NLC and TUC nor come meet dem say dem wan start strike naiem make dem shift bodi.

Dem tok say, “By di time wey we dey write dis statement, TUC wey CONUA submit request to join, never even tells us anytin about di strike.

“Make awa ogbonge comrade dem know say CONUA nor just fit go join strike wey dem nor let dem know about. Even sef di gum bodi wey we don with TUC dem never do am finish.”

Na for yesterday nite nai di organised labour say make all dem pipo wey gum bodi with dem nor go work till further notice.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM