+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

NLC Nor Try Me Cus Una Nor Fit Fight me — Presido Tinubu

President Bola Ahmed Tinubu on Thursday don dish some wotoski give Nigeria Labour Congress make dem know how to behave and nor dey see demsef as di only voice of di pipo.

Dis na afta di nationwide protest wey Labour organize for di kontri on Tuesday cus of hunger and agreement wey FG never fit meet with di union.

Na as Presido Tinubu dey commission Lagos Red Line Train wey go connect Agbado to Oyingbo nai he take drop di warning.

Oga Tinubu give am to Labour say why dem go dey blast govimet wey never even tay for office pass 9 months. And e nor  go resin anybodi wey wan pour sansand for hin govimet garri.

He say he know say corruption dey try to fight cus of wetin hin dey do but he nor go fall back.

Oga Tinubu assure pipo say all dis struggle wey dey show pipo pepper na just for small time cus e go soon finish, make pipo just bear am.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM