E don clear now say pipo wey wan go do education for college or dos wey wan do agric course nor go dey write UTME hagain afta JAMB make di hanacmet on Monday.
Na for dem X handle nai JAMB take say admission to Education programs and Agric program wey nor get relationship with engineering courses no go need UTME.
Na for dem meeting to tok about di 2026 admission nai dem take dey make di decision cus Federal govimet don bin tell dem say how pesin wey wan go korlley go dey sitdon for UTME, make dem stop am.
