+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Bandits Wan Tiff Hagain For Oyo – Police

Today Tuesday pipo start to dey run for some side of Ogbomoso and Ajaawa town wey dey for Oyo as news spread say bandits don enta Are-Ago High skool.

Online video of how di students take dey shele full grand bifor Oyo State Police Komand thru di PPRO DSP Ayanlade Olayinka say na fake alarm, make pipo nor fear.

Dem send police to di skool wey come meet Mrs Akanbi Ruth di skool principal, nai she say na some students nai karey di fake news as dem see strange face for back of di skool fence.
But laslas di pipo na hufica of NSCDC wey dey with Kwara State komand and two oda pipo for Toyota Venza SUV wey come visit one of dem babe wey dey do byday.

As some of di teachers see di pipo, dem come dey ask kwestun but kwarel come start, naso some students start to run spread mata say bandits don come hagain.

Di police sha say dem don ask NSCDC authorities for Ogbomoso to know di hufica and dem verify am but make pipo relax as calm don dey di area.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM