+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No Fear Say Banks Wan Close – CBN

Central Bank of Nigeria (CBN) don say make pipo nor fear for di with all di rumour wey dey fly around say govimet wan take over Union Bank, Keystone Bank, and Titan Trust Bank.

To make sure say pipo relax, CBN through dem Acting Director of Corporate Communications Mrs. Hakama Sidi-Alin, nai bring statement to say nor be true.

Wetin di statement tok be say nor be CBN nai karey di news so make pipo dey very careful with wetin dem nor dey sure about. Dem say CBN stand tanda to make sure say all financial system for di kontri strong and pipo moni nor lost.

CBN come still say make pipo nor vex but go ahead with any transactions wey dem dey do for bank.

Di statement say “Central Bank of Nigeria (CBN) don notice some report wey dey fly for some media house say FG wan take over some financial institution.

“Make e for dey clear, Nigerian banks dey safe and sound. CBN dey encourage di public to kwatinue with dem normal banking activities and nor resin any information wey nor come from CBN about any bank.

“CBN fully ready to do dem work to make sure say financial system strong for di kontri. So make pipo nor fear about dem moni for bank.

“So make bank customers do dem normal tin for bank , as quams nor dey anywhere.”

[The Nation/SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM