+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

No government go fit exist without security

The before before Governor of Anambra State Mr. Peter Obi, don talk say no government go fit exist without securing the lives and properties of the citizens.

Mr. Obi wen yarn dis one to take mark Naija 59th Independence Day, say d country need to do something sharp sharp concerning their present security situation.

Mr. Obi say one of the major things wen dem need for the country to grow d economy na investment, but still he come talk say he dey wonder whether d nation dey secured for investors.

He come talk say security na one major factor wen dey attract foreign investors.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM