No Senator receive #20 million as COVID-19 palliative-Sen. Ajibola Basiru

Ajibola Basiru wen be talk talk person for the senate don yarn say no senator receive N20 million as COVID-19 palliative. Basiru talk dis one wen he dey react to one statement wen Cairo Ojougboh, executive director of projects for the Niger Delta Development Commission (NDDC) make.

Ojougboh say senators and members of the House of Representatives get N20 million and N15 million respectively as COVID-19 relief money. But for one statement wen Basiru drop yesterday, he say make Ojougboh provide evidence to take back wetin he talk otherwise make he clean him mouth well.

Meanwhile senate don talk say dem go fit go court based on d accusations wen dey against the national assembly.

Share On:

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

Make E beta for you

Advertise with Us

© 2022 KpokoFM