President Muhammadu Buhari don talk say he no go gree make anybody use government money for campaign.
According to Garba Shehu, presidential spokesman, oga presido make the statement wen dem dey close the federal executive council (FEC) for Abuja.
Oga Buhari come tell cabinet ministers say make dem take advantage of technology take reach out to voters on the need for why the All Progressives Congress (APC) need to return for next month general election.