Christian for Nigeria don dey provoke cus of di viral video wey one northern Islamic cleric, Sheikh Yahya Jingir, use mouth spit say any Christian wey nor want Muslim-Muslim ticket make dem komot from Nigeria cus na dem get di kontri and Christians na just infidel.
Di tok pain Christians wella, stay on Monday di Chairman of Christian Association of Nigeria (CAN) wey dey for di19 Northern States and FCT, Joseph Hayab, for Channels TV say di way di imam tok na jusy to show how dem deg behave and see Christians for years now.
“We don dey keep kwayte since but make i go back. Dem don tok wetin worst but we get to know wetin we dey tok wey we come outside.
“If Jingir just say ‘Look, make we vote for our Muslim brodas to show say we strong,’ e for nor mean anytin but he come dey call us ‘infidel.’
“Di minute he komot from campaig turn to insult, then na anoda story. But dis na wetin dem don dey do Christians for long and e nor make sense.
