+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Nothing Do Di Shindren Book – Writa Reply Mrs Udoka

Mrs. Udoka Mary Queen, di mama wey read fron her pikin book how man burn dog with hot iron cus di dog nor fit look meat, bifor dem come dey trenten her say make she komot di video online, di writa of di book don hansa di moda of 2 shindren.
Writa of di book, Ayengbe Ebhohimen, say he don dey see di way pipo dey tok and dem only dey use sorry eye take dey do tins as di book na for 3-5 years wey dey learn how to read no be to learn lesson of life.

He say notin wrongwith di book but any pesin wey see sumtin bad na di side of eye wey dem take read am. Say if Udoka dey find moral lesson nor be for dos kind small shindren book cus dem nor even sabi read.

He say pipo nor dey look well bifor dem tok and nor be say pesin nor fit review he book but to say make govimet ban wetin don dey for years, na just witchcraft behaviour.

 

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2026 KpokoFM