+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Notin Go Make Me Nor Arrest Yahaya Bello – EFCC Chairman

Chairman of di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, wey be Ola Olukoyede, say notin go make am nor arrest di foma givinor of Kogi State, Yahaya Bello or he go kukuma komot as EFCC chairman.

Na wey di Oga of EFCC dey tok to tori pipo for Abuja nai he take say Bello dey run from arrest afta he don use Kogi State moni anyhow, dey karey am go give aboki wey dey change moni.

Olukoyede tok say to show he respect for Bello, only hin karey hand call am, but he say make EFCC come arrest am for e village.

Di chairman come tok case wey be say Bello give hin cousin broda $750,000 to karey go give aboki make dem change to go pay hin pikin skool fees for abroad.

He say na for January dem bin wan arrest Bello but dem get wait for Federal High Court decision bifor dem go for di arrest.

As court give order, one Govinor and 30 policemen come hide karey Bello komot, he say nor be say EFCC nor.fit stop dem but make blood no go flow nai make dem stop.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM