The people wen dey protest for Benikrukru community for Gbaramatu Kingdom of Warri South-West Local Government Area don promise say dem go continue to occupy Chevron Nigeria Limited facility wen dey for the area until their Managing Director visit where the oil spillage wen dem say their facilities cause.
The protesters wen include women, youths and other indigenes of the area come still talk say d tin wen Chevron Nigeria Ltd dey yarn say the oil spill no be from their Abiteye, Makaraba and Utonana oil fields no be true.
Chairmo of Benikrukru community, Mr. Solomon Eri wen reason wit news people on Monday come promise say the people no go rest until d company don do wetin dem want.
Mr. Eris come talk say the reason wen go make d protesters comot from the facility na when top management of the company wen their MD dey lead visit the place wen d okamuka for take happen so dat dem go know d level of damage wen the alleged oil spill from CNL don cause d people wen dey long side for d community.