+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Omo-Agege don call Oil Companies to come the region

 

The deputy Senate presido Sen. Ovie Omo-Agege don talk say na peace we need for Naija so dat the country go fit achieve their target for the 2020 Budget.

Omo-Agege, when yarn on Wednesday during their meeting come dey complain about the way wen the government take dey fashi the Niger Delta especially communities wen dey host multinational companies.

He come talk say make the headquarters of multinational oil companies come back to the region.

Meanwhile, the deputy senate presido don talk say he no support the reports wen dey play say the Zamfara state government sell one bar of gold give the Central Bank of Nigeria (CBN) for N5 billion.

Wen Omo-Agege dey contribute to one debate on the 2021 Appropriations Bill for yesterday Senate meeting, he come talk say the gold wen dem sell dey act against the laws presently wen dey guide the exploitation of mineral resources for the country.

He come talk say him constituents and other Niger Delta people dey worried about the matter, since all the pepper wen dey come from oil for their territory dey go the Federation Account.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM