+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Omoyele Sowore and DSS kasala for Obodo Naija

The presidency don finally yarn concerning wetin Omoyele Sowore, leader of #RevolutionNow movement dey pass thru for the hands of the Department of State Services (DSS).

E no reach 24 hours after the secret police free am before dem rearrest am again. This one so come make both people wen dey for d country and outside the country dey talk.

But wen Garba Shehu, presidential spokesman dey yarn for one statement yesterday, he come talk say Sowore na person wen the secret police get interest in.

According to Shehu, Sowore no be ordinary citizen wen dey just dey express him views freely for social media and the internet.

Still on still,

Supporters of Sowore still dey hold ground say no amount of intimidation or harassment wen go fit do d guy man anything.

Deji Adeyanju wen don dey speak against d way wen d DSS take hold d before before presidential aspirant wen come still condemn d way wen d state service take re-arrest am come talk say Naija democracy and rule of law must na something wen we must protect.

Meanwhile on top dis same matter,

The US Bureau of Democracy, Human Rights and Labor Affairs (DRL) don talk say dem really dey concerned say d DSS rearrest Omoyele Sowore wen be d leader of #RevolutionNow.

The bureau dey under the US Department of State, the equivalent of Naija foreign affairs ministry.

For one tweet wen show dis past weekend, the office come talk say d principles of democracy nia be respect for the rule of law, judicial Independence, political and media freedom and due process.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM