+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Oyo Ban Kprakpra Take Away Plate

E nor too tay wey Lagos State say dem nor wan dey see all dis kprakpra foam take away plate and plastic wey pipo dey use take buy food and package other tins for party.

Oyo State naw don jump enta di challenge as di second state wey go folow for take away plate baning.

For statement wey di Commissioner for Health, Oluwaserimi Ajetunmobi tok for meeting wey dem do nai di commisoner take say di danger wey full inside those kprakpra plastic plate nor be wetin dem go sitdon tok for one day.

Even though say e cheap to buy but di moni wey pesin go take treat sickness from di foam plate nai worse pass.

For di Food Safety Stakeholders Forum wey dem do for Agodi inside Ibadan, Ajetunmobi say di ministry wan make sure say di kind poison wey food sellers dey sell give pipo reduce.

Oyo don set up team like dis to make sure say dem pipo folow di ban for di state.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM