Peter Obi don confam say he don karey he dress and cap komot from ADC go enta anoda party NDC cus of di too much problem wey di party dey get.
Na for long statement wey Obi write for X on Sunday, nai he take say na cus too much problem, court case and ADC don divide nai make am am waka nor be say dem do am sumtin.
He say he still dey repsect David Mark, ADC chairman and Atiku Abubakar but di pressure wey dey wan kpai am.
