+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

P’Harcourt Refinery Get 475,000 Barrel of Oil From SPDC

To kip di promise wey Federal Govimet give say dem go start to produce fuel for Port Harcourt refinery, di Shell Petroleum Development Company don supply 475,000 barrels of crude oil give di refinery.

Na tru Bonny Oil and Gas Terminal for Bayelsa nai dem use take send di Crude to PH refinery according to Abimbola Essien-Nelson, di Media Relations Manager.

Di Media pesin say na last week nai SPDC start to supply di crude oil.

Even di Director of Shell for Nigeria, Osagie Okunbor, say na togedanes work with Bonny Oil and PH refinery nai dem take get dis success and she believe say di supply go steady for di Nigeria market.

Know say na last year nai Govimet work Port Harcourt refinery finish dem come even go break promise to start production afta Christmas.

Till today Monday wey SPDC tok say dem don supply some barrel of crude to di refinery.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM