+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

PHED Give Us Lite, Our Husband Nor Dey Touch Us Again– Port Harcourt Women

Women wey dey stay for Diobu inside Port Harcourt enta street today Tuesday March go Port Harcourt Electricity Distribution Company office for di state say heat nor dey allow dem husband knack dem.

Di drama be say di women dey cry say conji don hold dem too much as dem husband dey always complain say light nor dey and hear too much.

Different sign paper nai dei women karey with tins wey dem write like Lite nor dey, We Nor go Pay, The Heat too much.

Dem say di suffa don too much as di small  moni wey dem take dey cook food dey saawa cus dem nor dey use eye see di lite.

Leader of di women , Maria Ike say dem come out so di whole world go know wetin PHED dey do dem as even their business and family don scatter.

Wey tori pipo call di PRO officer for PHED, Livingstone Koko, hin say no be dem fault as na di wat power take poor for di kontri but dem dey try to make sure di state get lite.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM