+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pikin Wey Hass Girl Sell 800k, Police Don See Am For Ikorodu

Lagos State Command don confimate say dem don see di 8 months old baby wey one hass girl Ruth aokezie sell for 800k for inside Ikorodu side.

Ruth na hass girl wey one family employee thru agent for Lagos State to epp take care of dem pikin.

Di family wey dey stay for Shomolu, notice around around 2:00 for early mormor on Saturday Feb 3, say Ruth don vamus with dem baby.

Nai dem start to raise alarm come even put her pinsure for social media naso pipo take see Ruth for Ikorodu, but she nor dey with di baby, say she don already sell am for 800k.

But di tokpesin of Lagos State Benjamin Hundeyin, don confirm for X say dem don see di pikin today Monday, morning.

“As pressure don dey, di pesin wey buy di baby, leave am for Alade Market wey dey Shomolu,” Naso Hundeyin write.

Na so police take quickly go save di baby, karey am go give di parents and dem confirm say na dem pikin.

Police dey try to catch di pesin wey buy di pikin but e still dey run.

[SA]

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM