Pupo wey dey stay for Federal Capital Territory don dey blast Minister, Nyesom Wike cus of di way rain water cus flood for Wuse Zone 1, Katampe, Durumi, Gwarinpa, Gaduwa and Gudu including oda part of di state.
One video wey pesin share on X, dey show part of Wuse 2, plus Ademola Adetokunbo Crescent, di bridge near City Park, one plaza and diffen motor wey water don soak.
Many pupo don dey use am curse Wike say he just karey he own plan come Abuja to scatter di master plan of di FCT wey oda kontri dey jealos cus now he don make gutter det full and leak while di place wey be green areas, Wike din unction am to estate compani.
