+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Pipo Dey Try Wan Make Us Tire For Di Nigeria-UK Travel, Air Peace Chairman

E never tay wey Air Peace start to dey travel straight from Lagos go UK but e dey be like say dem don dey get problem as di chairman of di airline, Allen Onyema say outside airlines dey try wan push am komot from UK travel space.

As pipo don dey praise Air Peace for dem services, Onyema say foreign carriers don dey do advert to reduce dem price to $100, $320 and 350 wetin nor go even reach tak buy fuel for dem plane.

He say all di bad belle na to make sure say Air Peace tire nor dey fly go UK again, cus even for dem to get landing ground for Gatwick Airport na otwege.

Wey di chairman dey tok for Channels TV program, nai he take say if all these foreign carrier succeed to chase Air Peace komot from di route e go hard for dj kontri as even Naira wey dey wan boince back go cime fall again.

Oga Onyema say di govimets wey dey all dis foreign carriers, dey support dem pipo cus dem know say Nigeria na kontri wey dem take dey cash out.

Nai he come dey say make other airline wey dey for Nigeria join to dey travel go UK so that di monopoly go stop for all di international airport wey dey di kontri.

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM