+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police arrest taxi driver because he ask for transport money

One taxi driver for Ogun State, Mayowa Ayodele, don narrate how police officers for the state take arrest am illegally for seven months because he ask of transport fare from the officers.

Mr. Ayodele narrate wetin he pass thru give the Ogun State Judicial Panel of Inquiry wen dey investigate cases of police brutality for the state capital, Abeokuta, on Wednesday.

He say four police officers charter him motor on March 7, 2018, dem no come gree pay. When he come dey ask dem for him money, dem come arrest am and den later charge am to court say he dey burst pipeline.

He come talk say the officers wen do dis rubbish nia be Buhari Yusuf, Ehimere Anthony, and two others wen he no fit remember their names.

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM