+ 234 909 771 1005

info@kpokofm.com

Follow Us:

Police Catch Husband And Wife Wey Buy Pikin For N30k Form Lagos

Police don save one small one month old pikin from di hand of husband and wife wey dey karey am travel as dem own pikin.

Di husband and wife buy di pikin for Ajah side for Lagos and na with N30k dem take buy am from di mama hand before dem enta road dey go Anambra.

Na on Sunday nai police come catch di husband and wife for ontop of onitsha head bridge inside luxurious bus.

Even Deputy Superintendent of Police (DSP) Ikenga Tochukwu, wey be still di Public Relations Officer (PPRO) for Anambra State, confirm am say dem don even karey di baby go give State Ministry of Women Affairs and Children Welfare.

And dem come karey di husband and wife give National Agency for Prohibition of Trafficking in Persons (NAPTIP), make dem do their own investigation.

Police fit arrest di couple afta one passenger inside di luxurious bus wey dem enta, call dem command hotline.

Di pesin say e dey suspect say di man and woman karey pikin wey dem nor born, cause di baby dey cry but di woman nir fit give am breast and na breast di pikin dey find.

Commissioner of Police, CP Aderemi Adeoye, come say hin like as di pesin wey call dem sharp to make sure say dem nor tiff pikin.

Adeoye still praise di police as dem quick come attend to do mata wey call enta.

[SA]

 

Leave a comment

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Contact Info

Quick Links

About Us

Make E beta for you

Contact Us

Advertise with Us

© 2023 KpokoFM